Why we arrest Bobrisky again - EFCC


 Nigeria corruption police, di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don confam di arrest of celebrity crossdresser Idris Okuneye wey dey popular as Bobrisky.


Tori bin dey fly upandan say di anti-corruption agency arrest Bobrisky for airport wen im bin wan travel.


Tok-tok pesin for EFCC, Dele Oyewale confam to BBC Pidgin say true- true dem arrest Bobrisky.


"Na on Thursday evening we arrest am for Lagos'' Oga Oyewale tok.

Why EFCC arrest Bobrisky

Di Economic and Financial Crimes Commission say dem no just arrest Bobrisky to wicked or punish am, but im get to unfinished business with dem.


According to di EFCC tok-tok pesin, dem arrest Bobrisky so dat im go fit write statement sake of di bribery allegations wey im sama on some EFCC personnel.


"We fly am to Abuja to face di investigators of di case, we need am to make a formal statement to dat effect." im conclude.


Di EFCC no tok di exact time wen dem go release am, but dem say dem go release am wen im write di statement finish.

Comments

Popular posts from this blog

Ogun State Students Writing Exams Turned Back Home Amid NLC Strike

BREAKING: Nigerian Soldier Beats Phone Repairer To Death In Adamawa Over Girlfriend’s Faulty Device

Nigerian Government Declares Tuesday Public Holiday To Mourn Late Ex-President Buhari